Apply ur order To Remove Fulani, Na Residents Dey tell STF Commando
Written by Joey Shekwonuzhibo on April 4, 2022
Irigwe pipu for Bassa LGA for Plateau State don call di Commando for Operation Safe Haven, Major General Ibrahim Ali to apply him order to remove Fulani herdsmen from dia land till when peace go dey.
Some of di piping wey follow Jay FM tok on Monday after dem kpuff ten pipu for one attack wey wey shele for Bassa angwa for di weekend.
Jay FM hear say 19 pipu carry wound for body for di attack wey shele wen Irigwe pipu dey celebrate dia cultural festival to welcome rainy season.
Di bad men dem enter dia ritual ground for Chando Zerreci angwa com kpuff pipu.
Remember say di Commando for Operation Safe Haven been order to remove Fulani herdsmen wey dem believe say dey disturb di peace wey task force dey try conclude.
He say him dey regret say di order been dey weak and di pipu don call di Commando wey still be di General Officer wey dey command 3 armour Division to gather mind apply him own order so dat dem go stop di herdsmen