Award Winning Naija Artiste M.I Don Officially tie Knot With Him Lover
Written by Esther Nnadi on September 23, 2022
As our entertainment industry dey hot, make we yarn give una say, One of Naija finest rappers, Jude Abaga, wey we know as MI Abaga on Thursday bin officially tie di knot with him lover, wey be Eniola Mafe.
Di award winning rapper for April bin announce say, him go waka down di aisle with him then-girlfriend Eniola wey don be him wife now.
Di music star and him wife bin do their traditional wedding ceremony for Lagos on Thursday, September 22, 2022.
Di couple bin fine well well for dem traditional outfits as dem no fit even comot hand from each other.