Jay FM Live

On-Air

Current track

Title

Artist

Background

Pidgin News

We betta countri pipo, ontop matta as to politics ooo. E never reach twenty-four hours after US and UK embassies bin issue security intelligence report for Naija to dem citizens, Inspector-General of olokpa wey be, Usman Baba, don order for increase of security activities for Federal Capital Territory. In line with di new measures, di […]

Yesso we Betta countri pipo, as di matta dey hot so, make we move bodi enter political matters now, to tell una say, hmmm e be like say na miracle na him go fit helep di party of PDP to come to unity oo as per say, di Rivers State Governor, Nyesom Wike, dey talk […]

With di increase for damages wey don dey recorded across Naija due to flooding, di Nigerian meteorological agency, NiMET, don dey warn victims of flooding for Plateau state to relocate to higher grounds as rains fit show face for November. Already, di flood don take over seven Local Government Areas for Plateau State. Di  local […]

We dey touch light one tori toddy from Plateau state with judicial matters, to tell una say, Jos judicial division of Court of Appeal don yesterday, reserve judgment for di main appeal filed by Honorable Musa Agah and him Peoples Democratic Party, PDP, wey dey challenge di  judgement of di Election Petition Tribunal, wey declare […]

Vice presidential candidate of Labor Party, Yusuf Datti Baba-Ahmed yesterday talk say, e dey highly debatable to use di word massacre  as to describe di October 20, 2020 #EndSARS incident wey shelle for Lekki Toll Gate wey dey Lagos. However, he stress say, surely abuse of procedures and civil rights violations  bin dey too during […]

Vice presidential candidate of Labor Party, Yusuf Datti Baba-Ahmed yesterday talk say, e dey highly debatable to use di word massacre  as to describe di October 20, 2020 #EndSARS incident wey shelle for Lekki Toll Gate wey dey Lagos. However, he stress say, surely abuse of procedures and civil rights violations  bin dey too during […]

Federal government don talk say, dem no go  declare state of emergency ontop di ogbonge flood wey don Choke for some parts of di country dem never dey overwhelmed by di incident yet. Minister of Water Resources, wey be Suleiman Adamu, na him bin talk this one  during one interview for national television. With over […]

Still ontop di case of di Leader of di Indigenous People of Biafra wey be Nnamdi Kanu, Federal Government don issue one Notice of Appeal and Motion for Stay of Execution to di judgment of di Court of Appeal wey dey free di leader of di Indigenous People of Biafra, Nnamdi Kanu. IPOB counsel, wey […]

Ontop crime marraz wey dey shelle for we obodo Naija,we wan let una know say, troops don arrest two suspected fake fake National Identity Management Commission, NIMC, officials for Niger Republic for say, dem dey register non-Nigerians for National Identity Number, NUM. Di Director of Defense Media Operations, Major General Musa Danmadami bin give this update […]

West African Examinations Council, WAEC, go on Thursday, launch dem Digital Certificate Platform, na di join body of WAEC na im talk dis one. With this launch, pipo, educational institutions and organizations go dey able to confirm di genuineness of any WAEC certificate ontop di digital platform wey pipo go fit operate ontop Android and IOS […]