Current track

Title

Artist

Background

Pidgin News

Page: 2

Moving onto political matters this time, Presidential candidate of Labor Party, Peter Obi, yesterday bin map out some of him plans for di Northern region if e dey elected next year.  Mr. Obi bin make di revelations during him talk for di Arewa Joint Committee Interactive Session for Kaduna where him note say, improving security, […]

Ontop judicial matters for we obodo Naija, elder statesman, wey be Edwin Clark dey beg Oga Presido Muhammadu Buhari to obey di ruling of di Court of Appeal wey on Thursday bin fault di Federal Government for di manner wey dem for take hold Nnamdi Kanu matters and discharge am for terrorism charges. However, Federal Government dey […]

We don bring una tori from educational sector from we Plateau state, make we tell una say, University of Jos don resume academic activities following di decision of Academic Staff Union of Universities, ASUU, to suspend dem eight-month strike.    Unijos ASUU Chairperson wey be, Dr. Lazarus Maigoro wey follow JayFm talk ontop di development, […]

Ontop Di countri Politics Marraz, Rivers State governor, Nyesom Wike dey talk say, Peoples Democratic Party, PDP, owe Naija pipo dem one explanation and apology following some kind statements wey Atiku Abubakar wey be presidential candidate of di party bin talk.   Atiku on Sunday for Kaduna bin talk say, di  north no need Yoruba or […]

Onto party politics for di news, after some kind amebo wey dey go say Presidential Candidate of Labour party wey be peter obi bin collect donations, Oga Peter Obi don come out talk say, him no collect any personal jets from top top Naija pipo dem oo for him campaign.   Obi,  wey bi former governor […]

Ontop education matters wey dey shelle for we obodo Naija with di long back and forth between Federal Government and Academic Staff Union of Universities, ASUU, di union dey talk say, dem bin call off di eight-month strike due to one court order and abeg abeg wey bin also come from Naija pipo Dem.  One […]

Former BBNaija season three housemate, Patrick Fakoya, wey dey popularly Known as Rico Swavey, don kpuff. Pipo wey all of dem bin follow dey di Big Brother House during him season na dem confirm him death ontop different different social media platforms today. Reports before bin gather say, di former BBN star bin involved for one […]

As marraz for ASUU still dey hot wella, make we yarn una say, e wan be like last-minute change, as Academic Staff Union of Universities fit call of dem indefinite strike today. Remember say, Court of Appeal last Friday, bin order di union to call off dem strike with House of Reps wey kon chuk […]

Yesso betta countri pipo, this na tori ontop electoral matters. Former Chairmo of Independent National Electoral Commission INEC, Professor Attahiru Jega don beg electoral pipo say, make dem no give into any pressure by politicians wey no wan gree with say, make dem use Bimodal Voter Registration System, BVAS, for 2023 elections. Jega  wey bin […]

For di Tori this hour, make we start from national level where Federal Executive Council, FEC, for talk say, dem don start talk with Ethiopian Government ontop one subject of one visa ban ontop Nigeria, so that dem go fit comot di new policy. Minister of Aviation, Hadi Sirika wey bin talk this one during di […]