Pidgin News
Page: 3
For politics wey dey shelle as e dey hot for di news, Labor Party don talk say, dem Presidential Campaign Council, say na 1,234 members na im dey di party. Director General of di Council wey be, Doyin Okupe, wey bin follow tori tori pipo talk for Abuja, talk say, over 80% of new voters […]
Di World Bank Group don talk say, Niaja and other economies for Sub-Saharan Africa dey effectively tackle their economic challenges, including exchange rate crises. For one report wey Dem release yesterday, di bank talk say, di management of region economies don improve with di average score edging up to 3.2 for 2021 from 3.1 di […]

Ontop tori for we obodo Naija today,make we yarn una say, Lagos State Police Command don confirm di arrest of four members wey specialised for to dey put di lives of small small pikin dem at risk and dey use dem dey beggi beggi for street. Reports gather say, one person wey bin dey on […]
As di matta dey hot, make we tell una say, some hours after dem kidnap Oga Chairmo of People’s Democratic Party of Bokkos Local Government Area of Plateau State wey be Jerry Fwankis, tori wey just show face dey talk say, him don gain freedom. Dem bin kidnap di PDP chairmo yesterday evening for him […]

Socio-Economic Rights and Accountability Project, SERAP, don file one lawsuit against Oga Presido Muhammadu Buhari ontop di $23m wey ex Head of State wey bin General Sani Abacha bin loot. For one suit wey dem file last Friday for Federal High Court wey dey Abuja, Di group bin ask di court to direct and order […]
Untop issues between Federal Government and ASUU, Di Federal Government through National Universities Commission don order vice-chancellors to re-open schools and allow students to start lectures back. This one bin dey inside one letter wey dem sign by director of Finance and Accounts of di NUC, wey be Sam Onazi, on behalf of di Executive […]
As our entertainment industry dey hot, make we yarn give una say, One of Naija finest rappers, Jude Abaga, wey we know as MI Abaga on Thursday bin officially tie di knot with him lover, wey be Eniola Mafe. Di award winning rapper for April bin announce say, him go waka down di aisle with him […]
Ontop ASUU strike maraz as e dey hot for di countri, Join bodi of di union don talk say today today, dem go file appeal against di ruling of National Industrial Court by Justice Polycarp Hamman on Wednesday wey direct say, make members start work. Counsel for ASUU, Femi Falana, SAN, bin give this update for […]

Former Plateau state governor Joshua Dariye don thank Oga Presido Muhammadu Buhari for state pardon wey him grant am. Dem bin sentence Dariye to 10 years imprisonment ontop corruption charges for 2018 but however, Council of State wey bin dey led by Oga Presido Muhammadu Buhari kon grant am pardon for April 2022. Him bin enter Jos […]
Di latest one wey dey shelle for entertainment levels now be say, British rapper, Stephanie Victoria Allen, wey we know as Stefflon Don vow say, she no go ever date any musician again. Stefflon Don and her ex-bobo wey be Burna Boy, bin part ways ontop marraz wey e be like say, di dem no […]