Former Plateau State Governor, Joshua Dariye Don Thank Oga Buhari Ontop State Pardon Wey Dem Pardon Am
Written by Esther Nnadi on September 23, 2022
Former Plateau state governor Joshua Dariye don thank Oga Presido Muhammadu Buhari for state pardon wey him grant am.
Dem bin sentence Dariye to 10 years imprisonment ontop corruption charges for 2018 but however, Council of State wey bin dey led by Oga Presido Muhammadu Buhari kon grant am pardon for April 2022.
Him bin enter Jos wey be capital of Plateau State on Wednesday and him kon still sharpaly sharpaly thank Oga Presido Muhammadu Buhari for him help as dem take pardon am and him Taraba State counterpart.
The former governor also thank di pipo of Plateau for their prayers and solidarity during those times.