Join Bodi Of ASUU Don Dey Set To Appeal Industrial Court Ruling
Written by Esther Nnadi on September 22, 2022
For tori ontop Education marraz, make we yarn una say, Join bodi of ASUU, don talk say, dem go appeal di ruling of National Industrial Court of Naija, wey don order di union to call off dem nationwide strike wey dey go on like this and make dem start work back sharpaly sharpaly.
Di Union bin don start di strike since February 14 with one demand for government to improve funding for universities and one review of salaries for lecturers, among other issues.
Plenti Plenti meeting between ASUU and Federal Government bin go on wey no end for betta grounds since when dem start all di meeting, na im kon ginger and force Federal Government to challenge di strike action go court.
National Presido of ASUU, Professor Emmanuel Osodeke wey follow tori tori pipo dem talk, yarn say, di union go appeal di ruling, adding say, Federal government don deny Naija children dem their rights.