Stefflon Don Don Vow Say She No Go Ever Date Any Musician Again!
Written by Esther Nnadi on September 22, 2022
Di latest one wey dey shelle for entertainment levels now be say, British rapper, Stephanie Victoria Allen, wey we know as Stefflon Don vow say, she no go ever date any musician again.
Stefflon Don and her ex-bobo wey be Burna Boy, bin part ways ontop marraz wey e be like say, di dem no go fit solve am for 2021 after dem don date for two and half years.
For one interview with media person, TT Torrez for one obodoyibo New York-based radio state, Hot 97, Dem bin ask Stefflon whether she go ever wan date any man for di industry. Stefflon Don kon reply with say, She no go wan get anything to do with any musician again and she dey OK with her decision.