Current track

Title

Artist

Background

Top Top Ogas Dem And Presidential Candidate For PDP Don Shake Bodi Ontop Di Withdrawal Of Rivers State Governor From To Support Di Campaign Of Di Party Presidential Candidate For 2023 Elections

Written by on September 22, 2022


Leadership of Peoples Democratic Party yesterday bin hold one emergency meeting following di withdrawal of Governor Nyesom Wike of Rivers State, him Oyo State counterpart, Seyi Makinde, ex-Information Minister, Professor Jerry Gana, and other top top party ogas dem from di party presidential campaign council.

As per this development, di main opposition party bin don sharpaly do one marathon meeting to talk about wetin and how  this withdrawal go affect di party plan.

Di presidential candidate of Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar for di other hand, don react to di withdrawal of some party members, wey dey led by governor of Rivers State, Nyesom Wike, from him campaign team.

Atiku, for one statement talk say, him bin dey shocked with di withdrawal of Mr Wike and him ally but say, him no go fit force Mr. Ayu to resign unless di chairmo agreed to do so.

Him also talk say, him receive update by officials of di PDP that apart from Rivers State chapter of di party, all di remaining states for di federation bin submit names of people wey dem wan add for di Presidential Campaign Council.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *