Current track

Title

Artist

Background

Wike Don Talk Say, Atiku Go Pick Rivers Campaign Nominees Without Him Input

Written by on October 25, 2022

Yesso we Betta countri pipo, as di matta dey hot so, make we move bodi enter political matters now, to tell una say, hmmm e be like say na miracle na him go fit helep di party of PDP to come to unity oo as per say, di Rivers State Governor, Nyesom Wike, dey talk say, Peoples Democratic Party’s presidential candidate, Atiku Abubakar, bin no consult am before him bin pick him members of him.campaign council from di state.

Speaking for one inauguration of di Rivers State PDP Campaign Council for Port Harcourt, Mr. Wike dey claim say, Atiku go select enemies of Rivers into him campaign council for 2023 general elections.

Di governor still add say, Atiku photos and those of PDP National Chairmo, Iyorchia Ayu, don dey miss for di party campaign materials for di state because they no want am to campaign for di party for di national level.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *